Suffering Masses and Funny Elites

Date Feb 15, 2019
Location Ogun, Nigeria.
Value $15,000
ClientSeye Adenle
Category Pidgin Poet

 

E don tey!

wey we dey this struggle,
Yet the nation never bubble.

This shaky colonial framework
Don tire to dey suffer!
From the hands of bloody maga
But e be like say we self no bother.

UYet,we dey work harder
Like ejiro dey tell akpors
On top bed,say make he go harder!

Help us ask our landlords na
The greedy servants messengers
Why dem no dey see beyond
Their stomach?

Dem forget say soldiers must retire
Either he like am or not,
The one day,the

grave must chop am.

We get cocoa
Where the chocolate dey?
Shebi,we get oil
Why oyinbo dey sell am give us

Our pikin dey change gears
From hustlers to smugglers
Hackers to traffickers
See the road to Libya
The populace na from Naija.

Education no get meaning
Ask folake,
she go give you her reasons
How she trade her virginity to get a pass
She be no want do oooo!
But the oga give her condition.

See us as we dey thrive now!
Surviving with conditions
Graduating with conditions
Jobs with conditions
Trek the street,if your papa no get position.

“We go address and redress”
The situation
Mr lai is ready to tell us a lie
This na the change?
Abeg tell us say na game.

We believe in una drama
We dey see the fake trials
How you swings from broom to umbrella
How you employ animals
To become the modern day looters.

How a lawmaker turn to a singer
How that bros want to be an emperor
Make his son -in-law a governor.

Make una no forget
dem dey fight corruption
Yet,
certificate
fly through backdoor to frontyard

No be true,
Paper dey lie
The video was doctored
Case of the kano leader.

Oyinbo no tire to dey watch our game
Them say we be terrorists
Dem say we too corrupt
we, dey produce yahoo stars

Say,for our industries,
We no get experts
Dem say we too dull
We dey import everything

How come we no dey learn?
Correct our mistakes
Avoid the heart breaks

Yet I dey hear Atikulate
From another side,q
I dey hear Buharism

Naija no still dey me sense
Even with the new minimum wage
Let us correct our sensuous
I mean our sense
I hope say you get?

Another election is near
Shame the shame
Chase them away
Your vote get power pas wetin you think.